One vehicle wey dey loaded with guns and ammunition wey suppose dey meant for one armed robbery operations nain Intelligence Response Squad wey by DCP Abba Kyari lead in Asaba Delta State don intercept
Di suspected leader of di gang, Alfred Robinson sef don collect arrest and he dey rest for cell.
Reports say di weapons look like military grade and make people dey wonder weda dem wan start war.
Ogun State Police Command say dem don get intelligence report say members of various unlawful cult groups dey plan to mark wetin dem call “8/8” today,
Wey be 8th of August 2020.
Di state command don deploy SARS detectives, anti-culttism operatives, tactical squard and order all Divisional Police Officers DPOs and all Area Commanders to dey alert to forestall di celebration.
Di command tok tok person, DSP Abimbola Oyeyemi yarn for statement on Friday, say, di Commissioner of Police, CP Edward Awolowo Ajogun disclose say di intelligence report also reveal say di event may result tp bloodletting and wanton destruction of properties.
“So because of dis, di command wish to warn people wey get such devilish plan to get rethink and retrace dia steps as such move go meet with strong resistance from security agencies.
To dis end, all di command’s tactical squads namely SARS, anti cultists, anti kidnapping as well as all the DPOs and Area Commanders have been put on red alert to nip in the bud any act capable of undermining the security of the state,” he stated.
According to him, di full weight of law go descend on any member of any unlawful societies wey intend to use public places to perpetrate evil, as di Command nor go fold dia hand while some misguided and unscrupulous elements attempt to make life difficult for law abiding citizens of di State.
Di command therefore use dis medium to appeal to parent and guardian to steer clear of any unlawful gathering or society on before and after di said date.
Also, dem warn hoteliers not to allow any body use dia building for any cult-related gathering as owners of such facilities go dey liable for prosecution.
Dem assure members of the public to go about their lawful businesses without fear of harassment, intimidation and molestation, the command has rolled out all in its arsenal to deal decisively with anybody who tries to breach the relative peace being enjoying by the good people of the state.